'Etike Revo Wetin?' ('I Love My Country') | Wole Soyinka Feat. Tunji Oyelana & His Benders | 1983

preview_player
Показать описание
"Etike Revo Wetin?" ("I Love My Country")

Lyrics:

I love my country I no go lie
na inside am I go live and die,
I know my country I no go lie
na him and me go yap till I die.
I wan begin with history that war we fight in recent memory wey music wey come from barrel of gun.

Me I think I get cancer for me eye that's the reason why, cause when I look na two I see make I explain I think you go ‘gree.

I love my country I no go lie na inside am I go live and die, when e turn me so I twist am so, e push me I push am I no go go

Make you no worry both nations be friends, even when they fight they soon make amends when one back dey itch am, the other go scratch, when one lay egg the other go hatch, eggs na eggs but some are rotten, but make I tell you some are golden. I tell you my country no be one, I mean not to yesterday I born.

I love my country I no go lie na in side am I go live and die, I know my country I no go lie na him and me go yap till I die.

One go proud the other so meek, one go hide, the other go seek, one country go slap, the other go turn cheek, and assume dey are playing hide and seek. The lovely twins of whom I speak, Mr. Country hide and his brother seek. Country hide 2.8B he tell country seek, brother carry on, seek from Turkey to China sea, the more you look, the less you see.

You thief one Kobo dey put you for prison, you thief 10M na patriotism, dem go give you chieftaincy and national honour, you thief even bigger den go say na rumour. Monkey dey work baboon dey chop sweet-pounded yam, someday e go stop.

I love my country I no go lie na inside am I go live and die, when e turn me so I twist am so, e push me I push am I no go go.

One time we stack groundnut so high, like pyramid nearly reach the sky, palm oil dey flow from here to London. Cassava, plantain our fruits be champion, our cocoa compete with that of Ghana, mouth dey water to do the banana ... yam wey big like wrestler's thighs.

Which rice get fame like Tappa rice, but now to eat na half my budget, food dey cost like golden nugget, the rain wey flow from open sky e only float presidential rice.

...Where all this food disappear; my belly dey rumble abi you no hear…

I love my country I no go lie na in side am I go live and die, I know my country I no go lie na him and me go yap till I die.

The day dey bring green revolution, country seek say e get salvation. It give out shout, e think at last with green revolution e go end him fast. Education is good for me and you, so let's give praise where praise is due.

Green revolution was most educative and coincidentally most lucrative, education alone chop one quarter of the budget to teach the farmer what e never forget, posters left, and right and centre. Green revolution by government printer.

I love my country I no go lie na inside am I go live and die, when e turn me so I twist am so, e push me I push am I no go go.

But that was nothing but chicken feed; a nation in need is my friend indeed. Summon the chief chemical analyzer to tell us the magic of fertiliser. Country seek hear, I no be miser, billions dey hide for fertiliser.

I love my country I no go lie na inside am I go live and die, I know my country I no go lie na him and me go yap till I die.

© Wole Soyinka 1983.

Music & Lyrics by Wole Soyinka (1983).

Album Design by Ajayi K. Mokwenyei.

NB.

Wole Soyinka: His Satire Extended To Song
Рекомендации по теме
Комментарии
Автор

Just found this record in my dad's old collection.

beracha_od
Автор

I always knew this song but have never heard it in full.
I also never knew WS--Wole Soyinka sang and wrote songs.😀
Baba is a total package. Wa pe o Baba. A ma ri yi ba, pelu Ase orun!

liberatingthemind
Автор

Nigeria, Nigerians and Corruption.
What A Pity!
I Fear For My Future In This Country, Nigeria

obinnaigboeli
Автор

Thanks for this upload. These songs are evergreen and I really love them. Performed by our legends, we celebrate and salute you sirs. Privileged to be given a vinyl copy by Uncle Tunji Oyelana in the nineties (should have asked for an autograph to be honest😀). Thank so much Sirs!! Blesings

jidearowolo
Автор

We thought it was bad then with no idea that much worse was to come!

lelakogbara
Автор

Thanks for uploading this. 🥰🥰🥰
I swear Soyinka is the unrivaled king of satire and lampoon in Africa. This song performed by Soyinka and Baba Tunji Oyelani highlights evergreen issues.

literaturepadi
Автор

@Mr Adeyinka Makinde, thanks so much for this! If I won't be asking for too much, kindly post the other side of this record (the 'Chairman' song) if you have it. Thanks and God bless you!

jidearowolo
Автор

Interestingly creative, whilst subtly didactic !

titiakinyemi-tzvy
Автор

I CAN'T FORGET THIS SONG.
PERFECT LYRICS.

PLEASE CAN U UPLOAD, " TAKE THE FIRST STEP "

DamilareIkusika
Автор

Baba Tunji Oyelana sura the tailor and Prof. Wole Soyinka.

adebisijamesadeyemi
Автор

This music was released before the overthrown of Alhaji Shehu Shagari

bitrusdogara
Автор

Wole Soyinka is a big, fat disappointment.

omodiagbedominicedeoghon
visit shbcf.ru